Wia dis foto come from, Getty images /Caf/ @Lesvertes_dz
Wetin we call dis foto, Rasheedat Ajibade, Nigeria/ Lina Boussaha, Algeria
7 hours wey don pass
Di Super Falcons of Nigeria and di La vertes of Algeria go clash for di ongoing Women Africa Cup of Nations on Sunday.
Di final Group B match go happun for di Larbi Zaouli stadium, Casablanca around 20: 00 (8:00pm) local time.
While di Super Falcons of Nigeria don already qualify for di quarter-finals dem dey hope to beat Algeria to finish strong and top Group B.
For di La vertes dey also hope to top di group if dem win di match against Nigeria.
Nigeria get six points afta dem win Tunisia and Botswana while Algeria get four points afta dem beat Botswana and play goalless draw wit Tunisia.
Tunisia get only one point while Botswana get zero point.
Match facts
Nigeria don reach di knockout stage of all di 13 Wafcon editions.
Na di first time since 2014 dem dey start wit back to back wins.
Dem neva lose any final group stage match for Wafcon.
Chinwendu Ihezuo don score for di two matches wen she come from bench.
If Nigeria win dem go complete 100 percent group stage win record for di seventh time.
Algeria don get 4 points from dis Wafcon, dia best return for a single edition.
Dem don already qualify for di quarter-finals but if dem win dem go end as group winners.
Dem don lose dia final group game for watch of di Wafcon editions.
Dem fit finish di group stage witout any lose for dis first time.
Wetin di coaches tok
Algeria Coach Farid Benstiti wey don dey coach di team since 2023 tok say
” We want to come out strong to beat Nigeria so dat pipo go take us serious for di quarter-finals.”
Di former head coach of di PSG women’s team, dey come wit plenti experience. Since im take ova di team, Algeria don shown signs of progress, among di tins im don achieve na to qualify for di 2024 Wafcon finals afta dem miss di ast two editions.
Nigeria Super Falcons coach, Justin Madugu tell tori pipo say wen teams go out to play for competitions pipo dey always come up wit different records but dat one no be our major worry for now.
Di most important record na to win all your games and set di most important record at di end of di tournament. But na good tin say di team no dey concede goals, e show say we dey strong for defence. We need to work on areas wey we know say we need to do beta as we dey improve wit subsequent games.”
Dis na Algeria sixth appearance for di tournament. Even though dem dey consistent to qualify evritime, dis Les Vertes still dey struggle to establish diasef as one of di biggest sides for di continent.
Stats show say dem neva pass di group stage bifor, and dis fit be di first time dem go pass di group stage while dia opponent Nigeria na nine – time winners.
We go bring una live updates for here